Lyrics – Erigga – “Wahala” ft. Oga Network

Screenshot 2021 12 07 at 08.07.14
Screenshot 2021 12 07 at 08.07.14

Wahala dey
Wahala full here o
Country wey blind man dey count money
Wahala dey
Wahala dey
Wahala full here o
Armed robber dey call thief ole
Wahala dey

 

Oga DPO na who thief him phone for inside police station, abeg
Nepa office on generator dem no no wen light go come

 

As I dey follow you dey talk all my men don off
The loud wey we dey smoke dem no fit drag pass one puff
We taya for Nigeria matter I no fit lie you
Na wetin Fela and China talk still dey happen
Who rule go waste money work he no go do
Hustle don make boys forget wetin den read for school
12 years 13 years don dey do Yahoo
Dey look Epa wen nor dey do like big Malu
Epa don graduate for Ekpoma but no level
He find work he tire he kukuma join HK
According to am the rain wey beat am today, go wash im Benz tomorrow once e puma pay
For all the good men he dey jam no wan get shishi
I no fit judge d story don pass deeper life preaching
Since Jona no get patience he join taking
Na last week dem poof close to that bakery

 

Wahala dey
Wahala full here o
Country wey blind man dey count money
Wahala dey
Wahala dey
Wahala full here o
Armed robber dey call thief ole o
Wahala dey

 

Oga DPO na who thief him phone for inside police station wahala
Nepa office on generator, dem no no wen light go come
(how dem wan take know)

 

Dear Abacha small thing fit reach me
The last one you send come area we no see shishi
Stay at home but where the electricity
Nigeria na cruise I swear God forbid bad thing

 

Wetin dey occur my whatsApp na Mandilas
View my status na shoe, bag, hair and slippers
15years no dey sleep house she don enter street
Dey sell pussy for Lekki her Father against that shit

 

Cos na she dey survive dem alert steady
This generation don cast wen e go ending
Na Yahoo money make Aunty collect big slap cos 17years don too dey my snap
Nigeria now be like fowl wey no get owner
Who swear give us e no go better for una
Covid 19 grandchildren wey suppose give us cure
Don turn makeup artiste dey director pure

 

Wahala dey
Wahala full here o
Country wey blind man dey count money
Wahala dey
Wahala dey
Wahala full here o
Armed robber dey call thief ole o
Wahala dey

 

Oga DPO na who thief his phone for inside police station very bigi wahala o e dey here
Nepa office on generator, dem no know wen light go come
wahala dey here oo

 

Download mp3

Be the first to comment

Give Feedback About This Article